body-container-line-1

Am not the cause of man's evil on earth: Satan clears the air

By Gift Genius Wokoma
Opinion Am not the cause of mans evil on earth: Satan clears the air
FRI, 28 JUN 2013 2

Man wey sleep with another man wife go sey na satan, politician wey thief public money if them catch am, go sey na satan, guy man wey dey smoke ebo and police catch am go sey na satan ,police man wey collect bribe dem catch am go sey na satan, wetin satan do sef wey every body dey accuse am like dis, ah I need to hear from him mouth if true true na him dey cause all dis tin. In this critical, intense, precise interview with Mr Satan, also known as Lucifer with Gift Genius Wokoma, Mr Satan, opens up that he is not the cause of man's evil on earth but man's in ability love to his fellow brother in peace and unity to the Glory of God.

Journalist- yes Lucifer, wetin really happen between you and God for heaven wey him come ask Micheal to pursue you come earth

Lucifer- this question wey you ask me na better one and I go answer am with truth. You see heaven na place wey many angel dey, but out of this angels na me wey God love pass because of the love wey God get for me na him cum name me Lucifer wey mean beautiful, God come also give me better voice wey I dey carry sing for ram, but I fuck up

Journalist- wetin you mean by you fuck up

Lucifer- pride cum enta my body, I no come dey respect God who created me in his likeness. I con go deceive other angels join my body to go comot God for him throne, na dia God vex com ask angel Michael to chase me from heaven with other angels, so since then I dey beg God to forgive me so I go fit go back to heaven I don tire for this world

Journalist- so Lucifer u wan go back to heaven

Lucifer- yes nah, I don tire to leave for earth with man because when man do evil to him fellow man him go turn accuses me say na me cause am

Journalist- Lucifer, u mean say your hand no dey for the bad bad thing wey man they do on earth

Lucifer- Yes oh, see if my hand dey for all the wicked thing wey man dey do against him fellow man as dem accuse me, na which hand wey dey my body wey I wan go comot God my creator for Him throne? The truth be sey na man wey choose to do evil against him fellow man

Journalist- How?

Lucifer- Na because man choose to kill him fellow man, if man sey him no go kill him fellow man again, him no go do am, man get power to do good and also get power to do bad, but because of greed, love for money and power man prefer to do evil tin, and secondly ,man no get true love for him brother and where love no dey, peace and unity no go dey.

Journalist- So na because you no get true love for God na in make you betray am

Lucifer- Yes na, well my own greed, pride and hunger for power follow cause am too.

Journalist- How about politician wey dey thief dia country money wey dey go suppose use to develop their country, na wetin cause am

Lucifer- Because dem greedy like me, because dem no want development, because dem no get love for their fellow brother and country so na their choice, na wetin dey sow dem go reap

Journalist- So your hand no dey there too

Lucifer- after all, no be me wey tell dem to go thief their country money oh, na dem na in decide to thief the money for their personal use. The truth be sey dem greedy.

Journalist- Lucifer, how about prophet/pastor were dey do signs and wonders in the name of Jesus, dem be really servant of God

Lucifer- you know say everybody dey want easy wey to carry make money, see the truth be sey, no be sign and wonder na in make you servant of God, if you dey do sign and wonder and you get true love for your brother, you be fake man of God, you dey do signs and wonders and you no fit help poor people for your church and communities then you be fake man of God, God no sabi you, so you just dey deceive yourself oh.

Journalist- So wetin be your advice for men of God

Lucifer- make dem try live the life wey Jesus live for earth with their signs and wonders

Journalist- How about people wey dey practice homosexually wetin dey cause am

Lucifer- That wan na very bad habit oh wey human develop for demselves and e no good, because wetin God design na man and woman, no be woman and woman or man and man

Journalist: But na you cause am?

Lucifer: Ah, my hand no dey there oh,

Journalist- Wetin be your advice for those homosexual people

Lucifer- If you be homosexual person wey do am for fun or money, I beg make you stop am, because e no good and God dey vex

Journalist- Lucifer, e get group wey dem dey call church of satan and illuminatic and person wey join am dey go get money tru magical power, your hand dey there?

Lucifer- That one na imagination of humanity to carry make plenty money for themselves through membership registration and donation, see, to tell you sey dem be fake, you don see poor person wey join that group wey make money? No, the group dey only initiate people wey don get money already so dem go make money from this insecure people

Journalist- You don marry

Lucifer- No

Journalist- Why? u be homo

Lucifer- God forbid, no worry wen I wan marry I go invite you

Journalist- Lucifer this wan na the last question, you sabi dance?

Lucifer: Yes, I dey dance olamid music(go down low) well well for were I dey

Journalist: You mean hell fire?

Lucifer: hmmmmmmmmmm

Journalist: plays music

Lucifer: go down low( singing and dancing)

Disclaimer: "The views expressed in this article are the author’s own and do not necessarily reflect ModernGhana official position. ModernGhana will not be responsible or liable for any inaccurate or incorrect statements in the contributions or columns here." Follow our WhatsApp channel for meaningful stories picked for your day.

Comments

chuks | 6/29/2013 4:16:00 PM

yes, the writer of this interview must be highly experienced to tell the truth to the world because this days anything that human do they will turn and accuse satan for their own sin. lets change from our evil ways and start loving our fellow bothers and sisters

Just in....
body-container-line